Video of Deborah Samuel killed in Shehu Shagari College of Education Sokoto for alleged blasphemy spark reactions as police arrest suspects

Imam Oluwatoyin Yusuf

Wia dis foto come from, Facebook

Reactions still dey come in afta di gruesome murder of Deborah Samuel, one female student dem kill and burn for di Shehu Shagari College of Education, Sokoto state for north west Nigeria on di allegation of blasphemy.

Two ogbonge Islamic clerics Imam Toyin Yusuf and Sheikh Nuer Khalid follow BBC Pidgin chook mouth for di mata.

Imam Toyi Yusuf na lawyer and journalist wey pipo sabi for di south west while Sheikh Nuer Khalid wey pipo sabi as di 'digital imam'. na popular Islamic cleric wey dey use internet to reach im followers wit im preaching.

For Imam Yusuf, "di pipo dem wey stone and kill Deborah be murderers and dia action no represent Islam."

In di same way, Sheik Nuer Khalid wey pipo sabi as di digital imam say "even though di punishment for those wey blaspheme against di prophet and di Koran na death, di responsibility to kill no dey for di hands of di mob."

E add say "di pipo no get di right to kill Deborah and dat dem for either report am to di competent court of law to trial am for blasphemy."

Di school gate

Wia dis foto come from, Shehu Shagari College of Education

Meanwhile Police for Sokoto state north-west Nigeria say dem don arrest two suspects- both of dem students of di college - and dem dey track down more as investigation into wetin happun for Shehu Shagari College of Education wey lead to di killing of Deborah Samuel continue.

Authorities shut down di college indefinitely and order say make all students go home immediate

Pipo wey take eye see wetin happun say di violence for di Shehu Shagari College of Education bin start wen di student - wey dem say be Christian- dey accused of making comments on social media dwey dem tag as blasphemy.

Dis wan cause angry reaction from some Muslim students wey allegedly kill her and set her body on fire. Police identify her as Deborah Samuel.

One police tok-tok pesin say rioters bin also destroy property for di college and block one major highway.

Reports say Deborah be 200 level economic student of di school.

How Deborah Yakubu take die

One tori pesin wey base for Sokoto tell BBC Pidgin wetin happun.

"Dis morning around 9:00am problem start afta one female student of di school allegedly insult di name of dia holy prophet"

"So some student for di campus drag her out from her hostel and start stoning her and some dey beat hear wit stick"

Den dem kill her and set her bodi on fire.

Pesin dey tok

Viral videos on social media dey show footage wey be like di same account of dis Sokoto tori pesin.

However, BBC Pidgin no fit independently verify di content of both di viral videos and voice notes.

Di tori pesin Abubakar Imam add say; "From wetin I see, di student use dia WhatsApp group to make di comment"

"Dem set up di WhatsApp group for discussing academic activities and oda tins, so one student post something on religion on dat group"

"So di female student comment ontop di mata and in di process of commenting and condemning di action of dat student, she den use di 'blasphemous' words.

Wetin Sultan tok?

Dem dey old meeting

Di killing on Thursday don dey widely condemned by both Muslims and Christians across Nigeria.

Di most senior Islamic religious leader for di kontri, di Sultan of Sokoto, Sa'ad Abubakar, wey dey based in di city, describe di violence as ''unjustified'' and call on di authorities to bring di perpetrators to justice while e call for calm.

Reactions from CAN, Amnesty International and odas

Di rights group Amnesty International describe di killing as ''horrific'' as dem call on di authorities to bring di perpetrators to justice as well as take measures to end ''di impunity wey lead to an increase in mob violence'' for di West African country.

Meanwhile di Christian Association of Nigeria (CAN) don condemn in strong terms di gruesome murder of Deborah Samuel by who dem say be extremist fellow students on allegations of blasphemy.

"Di unlawful and dastardly action of di perpetrators must not only dey condemned by all right thinking pipo but di security operatives must fish dem out, prosecute dem as e dey expected of dem" Dia statement tok.

Di Catholic Bishop of Sokoto, Most Reverend Mathew Hassan Kukah also appeal for calm while e call for justice. Inside statement, di bishop say make dem treat di ''inhuman'' and shocking killing sas a ''criminal act'' and not religious.

pesin dey tok

Di govnor of Sokoto state Aminu Tambuwal describe di incident as saddening and offer im condolences to her family. Afta meeting with religious leaders and security chiefs, di govnor promise say di perpetrators go face di law.

Govnor Tambuwal for Sokoto do closed door meeting wit heads of di security agencies for di state as well as di state chairman of di Christian Association of Nigeria, CAN, Rev. Fr Nuhu Iliya for goment house to discuss di mata.

Wetin be blasphemy and wetin di law tok about am?

Imam Oluwatoyin Yusuf

Wia dis foto come from, Facebook/ Oluwatoyin Yusuf

Wetin we call dis foto, Imam Oluwatoyin Yusuf

Blasphemy na di action, offence of speaking out of place - sacrilegiously, insulting God or sacred tins.

To say sometin bad about God or use im name in vain.

Imam Yusuf say "no section of di Koran support say make anyone kill im broda or sister."

E further explain say "those wey kill Deborah be criminals and dia action no represent any religion."

On wetin Islam define as blasphemy, e say "di word blasphemy no get root for Islam and Koran and so di Koran no get any punishment for anytin like blasphemy."

Meanwhile, di Digital Imam Sheik Nuer Khalid dey of di view say "even though di punishment for those wey blaspheme against di prophet and di Koran na death, di responsibility to kill no dey for di hands of di mob."

SHEIK NURU KHALID

Wia dis foto come from, SHEIK NURU KHALID

Wetin we call dis foto, SHEIK NURU KHALID

E say, "di pipo no get di right to kill Deborah and dat dem for either report am to di competent court of law to trial am for blasphemy."

Oga Khalid further explain say "blasphemy for Islam na wen pesin insult di holy prophet or oda holy places or di Koran."

Meanwhile di customary law against blasphemy dey for Section 204 of di Criminal Code of Nigerian law book.

Dat section forbid any act wey publicly insult any religion and put a prison sentence of up to two years as penalty.