
Tarro feel dis when im shake John Paul II hand. Him call am "articular prana," say e fit commot pain.
"Prana" na "breath," "life force," or "vital principle" for Sanskrit language. As Hindu believe, e dey every place.
Tarro say im save John Paul II life after dem try to kill am for 1981 when the Pope lose lyk 3 liters of blood, and receive blood wey come give am infection.
"One Polish fada call me, im secretary, and I reach Rome shap shap come see say im dey sick. I no tink, I just decide to treat the infection, wey from virus, with interferon," according to Tarro.
Dem dey use interferon treat both hepatitis B and hepatitis C.
Foto: © Mazur, CC BY-NC-SA, #newsWdqirxzzsl