ig.news
16

Archbishop wey no get Work don go back to im Old Work

Paris Archbishop wey im name be Michel Aupetit, 69 years, don volunteer to treat coronavirus patients, na wetin him tell LeParisien on March 25.

Aupetit don do medicine for wetin pass 20 years before im come become priest.

Him don dey discuss with the State how him go rearrange the churches wey dey closed make them use am house people wey don catch the coronavirus and 55 Paris priests wey go dey attend to coronavirus families.

Them fit give "Sacrament of the Sick" give people wey want am, na wetin im suggest.

Aupetit no dey worry say as dem close all churches, say im go affect Catholic people faith, "but apart from that, I tink say this wahala go bring our faith up again."

Him believe say him sef catch the coronavirus, because 2 weeks wey pass, im say him just no fit smell again, but no sign come again.

Foto: Michel Aupetit, facebook, #newsLuprlncpji